zeno
Create a Station
Explore
Religious
Music
News
Podcasts
Bible
By Genre
By Location
By Language
Download App
Toggle Sidebar
zeno
Adventist World Radio
AWR- Voice wen dey ginger Hope
Religion & Spirituality
Christianity
English
De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday
Website
Episodes
295
30 May 2026
Praise - God word wen we dey take grow
Today fess song say God good well well and de sekond song say make we no give up.De message of Hope say as we dey get fait and patience dey pray and as God dey ansa hawa pray we go con know God for hawasef.
29 min
29 May 2026
Woman dem mata - God word wen we dey take grow
Woman wen get handwork wen e dey take get hin own moni and e dey do de work well na happi woman.De message of Hope say wen Jesus save Mary Magdalene commot for de hand of de pipo wen want stone am make e die, e come know Jesus as hin savior.
29 min
28 May 2026
Family mata - God word wen we dey take grow
Man wen go bi beta husband na man wen get God for hin hat and wen go do watin God want make e do.Today message of Hope say e no mata watin you don do for yor life, Jesus go fit save you and klin yor slate and give your new life
29 min
27 May 2026
Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take grow
De sikness wen dey scatar pesin liva if e dey body wen doktor dey call hepatitis naim we put mout today.Today message of Hope tell us how Peter take do watin Jesus tell am and e con know say Jesus naim bi God pikin wen come save we.
29 min
26 May 2026
Pikin dem mata - God word wen we dey take grow
De kain kain way wen pikin dem dey take do wayo for deir exam wen no good naim bi today tork.Today message of Hope say de woman wen Jesus forlow tork for well come know say Jesus naim bi de Christ and na so hin town pipo con take save.
29 min
25 May 2026
Family mata - God word wen we dey take grow
De way wen bitaness take dey scatar de waka wen we dey forlow God waka naim bi today mata.Today message of Hope say even Rehab wen bi ashawo con know God and na so hin life take change and God sef redi to change yor life today.
29 min
24 May 2026
Praya - God word wen we dey take grow
Today praya na for Kebbi State, make God epp make all de wahala wen dey happun for deir stop.De message of Hope say na pesin wen chop food know say e sweet so na only as we gie Jesus hawa life we go know say God na good God.
29 min
23 May 2026
Praise - God word wen we dey take grow
Today two songs dey tell us say God dey ansa praya and e go ansa hawa praya so make we pray.De message of Hope say make we put thanksgiving and praise for hawa praya bikos God dey tru-tru ansa praya.
29 min
22 May 2026
Woman dem mata - God word wen we dey take grow
Woman wen sabi chop well, sleep well, get friend wen e dey forlow put stori and know God as hin papa na happi womanDe message of Hope say wen we pray make we humbo and make we no get enimi wen we no fit forgive and God go ansa hawa praya
29 min
21 May 2026
Family mata - God word wen we dey take grow
Man wen sabi trust pesin and wen dey forlow God, dey do watin God want and love God with all hin hat na beta man to marry.De message of Hope tell us say make we pray from de bottom of hawa hat, make we get patience and make we no give up and God go ansa.
29 min